Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 2 users
Topic OP
Try get good sense of humor, e get why
by
DubemIfedigbo001
on 07/10/2023, 06:47:54 UTC
⭐ Merited by hugeblack (1) ,fillippone (1)
Welldone my people, I say make I carry this topic come here for people wey dey too serious and no dey delay to tackle another person angrily as talk burst out. No be so e suppose be my people, try converting the matter to fun and everybody  fit concur, follow you laugh and the matter go just end there with no hard feelings.
Now good sense of humor na when you dey try see the funny side of any matter way dey ground and you try use play play pattern  follow up the matter. You fit bring down the mighty and strictest person with your sense of humor as it'll be seen that you're not dragging authority with them, you fit even Comot for trouble or even make person way for tackle you repent from  em intention. You can even win the powerful to your side and have then buy your Idea simply because of your striking personality.

Make I yarn Una this small tori wey happen to me.
Yesterday, my boys dem carry the office generator dey go where them go repair am, dem carry the gas cylinder wey em dey use follow body.  Police catch them for road, hold the generator and keke, say make them go carry the receipt come. As them reach office yarn me the matter, I wear company polo follow them with the manager to the check point. The manager just dey para for road, dey shout, dey talk plenty why them go  try that kind rubbish and other mumu talk them. I no even reply her as me I dey  craft strategy for my mind how I go take no spend shishi for that matter cos na only the gas cylinder receipt I see carry follow body. As we reach the checking point, I told my manager not to say any word so she doesn't complicated issues for me as her head too dey hot.
As I go meet the officer, em ask me If I don come to beat am or arrest am cos na receipt em demand. I just smile and told him say my morale no reach, say my boys update me on the measures em take to protect my office properties and I thanked him for that. The officer felt so good and started telling me stories on how em don catch plenty people wey steal properties under the disguise of relocation. I was just very busy supporting him and after five minutes of happy discussion, he released the items, shook hands with me and even forgot to check the gas cylinder receipt. Na then the keke man begin para for me say we don waste em time, person wey just escape arrest as theft accomplice. I apologized to him though, even the manger begin dey smile say thank God as we take settle the matter like friends. In conclusion, the moral of this story be say make we no dey use violence dey settle case, but with good sense of humor. You fit relate as mine saved me from police trouble.

I go still mention say good sense of humor dey different from being cunning. cunning attitude is just to deceive people and take undue advantage of them and shouldn't be confused for good sense of humor.