Some times I wonder if this our government dem really value this people them call their children, I mean all these our NYSC bordas and sistas wey don devote their time and lives to serve this our contri. E don dy almost go plenty plenty days and weeks now wey them kidnap some NYSC members for Calabar and our government no dey put force to bring them out, and with this act I no sure say people go fit summon courage to go serve.
No reason am say our government no value Corper’s ooo, I just serve finish this year and I know how government take dey put effort for Corper’s, even d amount wey dem allocate for Corper’s for camp no be small money, na just Nysc officials just dey corrupt wey dey always chop money wey dey suppose use take care of Corper’s. Anything wey government dey do, dey no dey carry Corper’s mattar play.
We know the level of insecurity in this country, everywhere is no longer safe, na y we suppose dey very careful be that, make we know how we go dey commot and places wey we go dey go. Corper’s wey no even sabi anything about place wey dem dey, na dem suppose dey careful pass. The way you talk say government no dey put force to safe Corper’s wey dem kidnap for calabar, you no fit just expect say police enter where those kidnappers dey make dem come dey kill the kidnappers wey u know say Corper’s wey dem kidnapped dey among them, you go kill some of the people wey dem kidnap be that now, in a case of kidnap, you have to be very careful when u wan rescue people wey dem kidnap, because if you are not careful, they will end up killing those hostages.