Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: 6 AM to 4pm job
by
Asiska02
on 09/10/2023, 10:46:18 UTC
Jobs for our country here sucks , just imagine person comot for house as early as 6 A.M go work and e comot for work by 4pm enter road, meet traffic congestion, come reach house by 6pm. Does it really worth it with The minimum wage of 30k naira. This working system no dey favour our country piple. Na still same thing with company work.
Some work self no get  resting day , from Sunday to another Sunday.

No be say Nigerians like most of dis works wet dey stress dem out o, but dem no get options dat is why dem settle for such type of works. I no think say dem go get any government work wey dey tedious like dis sef, 6-4PM no be joke oo. Most of companies dat do dis type of work na private companies and wetin dem dey do be say dem dey take advantage of dis worker because dem no get any oda choice asides working with dem, only few private companies put dis into consideration. And for government work wey require working round d clock or for a long time like dis, most dey be shift for dem to be having enough rest. Even though d government dey put dis into consideration, the minimum wage no still fit compensate all of dis, I hope dem go look into dat soon and increase d minimum wage because even if na me dey dat shoes, I no go like am like dat.