Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Will Bitcoin have a chance in Nigeria if?..
by
CryptoGirl_200x
on 09/10/2023, 16:15:52 UTC
This na something wey me self don sometimes reason am say, one of the reason why USA government kind of dey helpless in terms of banning bitcoin na due to the fact say, there are many of her citizens wey don invest heavily for bitcoin, and this no be just ordinary citizens, but people of high calibar, people wey fit move and turn the economy of the country due to their kind of influence.

So for me, i believe say if the big people way we get for naija fit begin investing in bitcoin and making it public like those wey dey US dey do, e fit change the narrative wey our nigerian government get towards bitcoin and cryptocurrencies in general.

And to also add, they no need to make the investment personal, they fit use the name of their company invest, the same way wey Elon musk use him Tesla company name invest in bitcoin.