Jobs for our country here sucks , just imagine person comot for house as early as 6 A.M go work and e comot for work by 4pm enter road, meet traffic congestion, come reach house by 6pm.
Dem dey call am 9 to 5, that's job wey you go do from 9 to 5 but for Nigeria na 8-5 as job dey start officially by 8 and end by 5, anything else no be working hours and we no suppose dey work to those time unless you dey work for where e demand you to stay pass that hour. Minimum wage no mean say na wetin dem dey pay people, na just minimum like people no supposed get pay lower than that amount and most job dey pay pass like dat. You no need to kill yourself my brothers, if you dey do job wey you no like no talk say you go manage am oh, commot for that job because e fit be that job wey dey weigh you back from achieving your goals for life. Some jobs dey like bondage and their boss dey use juju tire everybody down abi you never noticed say e get people wey go change job and immediately their life go dey better.
Abi na like this e be for other countries? No wonder many person like dey self employed.
9-5 dey everywhere my brother, e no get country wey you go go wey you no go see people dey suffer like this. The only better thing for their side na say their money get better purchasing power and dem dey pay dem well. Here dem no dey pay us well and our money no get value. Money wey dem pay you, you no go fit use am buy anything for market but their side you fit survive on your salary and feed well (do other things too). All this one na because say our economy no good which is due to bad governance. Self employment no easy oh, e hard because you need to work before you chop and your working self no guarantee your choppings unlike when you go receive salary irrespective of how you work.