Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: 6 AM to 4pm job
by
letteredhub
on 09/10/2023, 22:26:18 UTC
Jobs in our country here suck, just imagine a person who comes to the house as early as 6 A.M. go work, and e comot to work by 4 pm enters the road, meets traffic congestion, come reaches their house by 6 pm. Is it worth it with The minimum wage of 30k naira? This working system no dey favor our country people. Na still the same thing with company work.
Some work self no gets a resting day, from Sunday to another Sunday.

Abi na like this e is for other countries?.
No wonder many people like dey self-employed.

Me I believe say among those of us wey dey here fit hold political office tomorrow, abeg make we reason this matter.
The 30k salary no worth this kind of job but e better past to stay idle, and be do nothing, and you no go worry person for money every time to avoid see finish. Even as you dey suffer dy go the work try to look out for skill way be hot cake to learn and save the money small small from your salary to use learn the skill.
Nah this tok of say e better pass to stay idle na don make many gradutees son settle for less jobs for dis country wey na waec cert piple supos do. How as a graduate wey pay sch fees of 50k in a level go finish sch com comfortably dey do work wey salary no even reach your sch fees amount for university you go. And now these companies and private schs don take am as normal tin 30k for  dis current Naija wey economy hard lik dis. E better I bcom self employed and have control of my time and movement.

I rememba wen I first finish NYSC those first three months was hell as I been dey move from one office to another looking for job, even the worst part nah those private schools wey dey tok to pay me #25k in a month after I go de  handling 4 different subjects for two different classes. Only transport I will spend in a month don collect 6% of that salary and I go get to eat in the afternoon for sch oh. Like after reasoning all these tins I gat run back to forum after abandoning my account, I refuse to settle for less in the name of e better to no stay idle , I put in effort doing the extra ordinary now today nah me dey here. So wetin I dey try tok be say no be everytime e go dey reason those kind lines dem, e go make us no fit pursue our dreams wen we settle for less.