Jobs for our country here sucks , just imagine person comot for house as early as 6 A.M go work and e comot for work by 4pm enter road, meet traffic congestion, come reach house by 6pm. Does it really worth it with The minimum wage of 30k naira. This working system no dey favour our country piple. Na still same thing with company work.
You are even talking of worker that work for only 10 hours I no say dem no dey work oo but did you ever ask those that are working in the POS hmm my brother people dey suffer for Naija oo POS worker day work for 12 hours or more than that and the amount way them dey pay them go shock you because dey pay some of them 10k some 15k some 20k if you see say you collect salary for POS wey reach 25k nah for big POS you day work wey dey get high profile if not you no go collect more than that 15k
What I can say is even though the government no get job opportunities and we day try our best create self employment and other job opportunities to others we should consider the lot of work dey do and pay them in good amount that dey can also enjoy their life without suffering if not we will end up cheating our self every day and getting our workers in to depths