my country people, I just say make I bring this new as the thing really dey pain me Wella. the country matter don tire me and many off us don confirm say the country dey worst even more. just dis morning, as I come dey check news na e I see this one wey talk
say cooking gas now na 1000 naira per kg and go likely increase for some places to 1200 per kg.
dis one pain me Wella as I come dey wonder weather our government want make people die for this country. normally, if all these petrol product dey go up, we no supposed dey fear if we get other source of cooking like light. light no dey, fuel price no be here. even kerosine come cost pass all of them. how common man go fit take survive for the country. watin dey cause the increase nobody knows and government jus dey silent. well, I no go took shout as we all don dey used to the problem for nija and no be new thing. but I wan use this topic take recommend another better alternative wey one of our members for nija board don drop with us for here to take battle these hard time together. I go advice make una also share Dem with una friend and neighborhood make Dem still try am if e go work for them.
Another better source of household fuel Available(methane gas)by DubemIfedigbo001this one na better and easiest source of gas wey I don hear about so far. I never try am sha but I go like make all of una try check am. Lastly, we should all add Nigeria to our prayers everyday because this country will not grow if we just sit down and don't do anything.