Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: As our economy dey so, Bitcoin na blessing to us?
by
Samlucky O
on 10/10/2023, 21:18:50 UTC
If to say Bitcoin de centralized, foul play for de on how to control d price and others, but as it is decentralized, everybody get right to control him bitcoin d way wey him like and anytime.

Furthermore, Bitcoin don provide means of income to so many people including me.
Wetting you can na true. say if bitcoin dey centralized say foul play for dey am. Naim be the reason why government put the ban on crypto. Because them wan do something wey no go favour them. If to say people gree say make crypto currency dey centralized, Dem for no ban am.

I been dey think of how government go allow the citizens to fully adop crypto currency for every online transaction, and to receive bitcoin in binance and Cash out from local bank. But when I reason say that time e no go dey decentralized rather centralized. And Dem go dey penetrate the Bitcoin wey dey your wallet say na tax,vat,sms charge or even maintenance fee.there making you not to have total control over your Bitcoin account just like local bank. So I come dey talk say make them no even remove the ban again because na the ban dey make us enjoy p2p transaction.

Another one na how Bitcoin don provide means of income. reduce unemployment, cyber crime, scam and many more. And with time corruption go reduce drastically because if BITCOIN touch your life e no go remain the same again. I must confens say e don alleviate poverty. Apart from God the only saviour we have in this world is BITCOIN. Sometimes I ask who gave Satoshi nakamoto this idea? It can only be God.