One fact about rich people be say Dem no dey like lazy people. That's why some people no ft get help from there uncle or friend. when dey see you Dem go dey hide because them no say na beg you wan come beg them. But if you dey hardworking, Dem go like to come close to you because They no say you no go beg them again.
So make we no dey procrastinate or too much depend on people because time waits for nobody
Thank you.
Bro this your talk sweet me well well because no be even your uncle alone na everybody because they go dey assume say na money matter you dey bring so dey go dey hide for you. Person need to hustle because if you dey depends on person that one dey dangerous because any thing fit happen either the person go fire you or the person go die, then if any of this happen you Don go square zero be that.
In this world wey we dey now we need to be honest to ourselves and must believe riches comes from God and no amount of hard work you do will make you rich but still don't relax stand and take a step.