My country people! Really time wait for nobody. Many of us here get skills but Lack the courage to work towards am. Say man of God prophesy to you say you go be the richest man for your family no mean say d dream must come true.
If you no work towards am you go still be poor man because Dem say faith without work is dead. many talents dey waist because of pospondment. Wetting you don sabi you go dey doll yourself, dey see yourself like you never mature for the job or time Still dey. When your mate don meet up, you go come dey envy them say na juju or na yahoo then dey do, were as you get that opportunity.
One na make I see result from people wey dey do am first before I go do. Na still time you dey waist.
And another na to find Fault in people. This person no dey gree help person, him dey greedy upon all the Money him get him no fit help me.
The country hard. 9ja na the survival of the fittest, so to make am you no need to do like your life depends on people. Work hard and you go see the results.
One fact about rich people be say Dem no dey like lazy people. That's why some people no ft get help from there uncle or friend. when dey see you Dem go dey hide because them no say na beg you wan come beg them. But if you dey hardworking, Dem go like to come close to you because They no say you no go beg them again.
So make we no dey procrastinate or too much depend on people because time waits for nobody
Thank you.
Even if you dey do hard work like tomorrow no dey, no be everybody get mind to come close to you, your friends fit first you sabi way of making money them no go like give you money if you feel like say you are disturbing them they should show you way so that you can provide for yourself, that's when you will know the kind of friends or relatives you have because we can't just keep disturbing our friends or family about our problems. But it's better to show me how to catch fish better than how to eat fish, i know say one day it will tire him it's better for me to start making it myself.
Many people are trying their best to become better person and bring the best out from them, but how this country still be you can't just have talent and be thinking you can use it and make money,maybe this country has been cursed I just don't understand, hard work and pray that is all we need to be doing for ourselves and survive this country things are still getting hard for the youths, you go just dey see everybody complaining and is all about money nothing else, as fuel prices first increase we be dey think say na better thing wan happen to our country and see wherever we are heading to this time around. Time really wait for nobody and we don't have to give up in whatever we are doing.