Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Time waits for nobody.
by
Timmzzy
on 11/10/2023, 08:18:50 UTC
My country people! Really time wait for nobody. Many of us here get skills but Lack the courage to work towards am. Say man of God prophesy to you say you go be the richest man for your family no mean say d dream must come true.

If you no work towards am you go still be poor man because Dem say faith without work is dead. many talents dey waist because of pospondment. Wetting you don sabi you go dey doll yourself, dey see yourself like you never mature for the job or time Still dey. When your mate don meet up, you go come  dey envy them say na juju or na yahoo then dey do, were as you get that opportunity.

One na make I see result from people wey dey do am first before I go do. Na still time you dey waist.

And another na to find Fault in people. This person no dey gree help person, him dey greedy upon all the Money him get him no fit help me.

The country hard. 9ja na the survival of the fittest, so to make am you no need to do like your life depends on people. Work hard and you go see the results.

One fact about rich people be say Dem no dey like lazy people. That's why some people no ft get help from there uncle or friend. when dey see you Dem go dey hide because them no say na beg you wan come beg them. But if you dey hardworking, Dem go like to come close to you because They no say you no go beg them again.

So make we no dey procrastinate or too much depend on people because time waits for nobody

Thank you.


Op menhn the rate self at which i dey see people dey depend on people now adays just dey tire me, social media own na beg beg people full am now, just small lets say maybe your picture fine or lets say you post pictures menhn you go start to get beggers for dm if no be card na one thing one thing and some account now na guys dey use am beg, me go dey ask my self is it that this people no get two hands and leg the way others follow get.