Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Why E Go Be Prayer?
by
SmartCharpa
on 12/10/2023, 10:45:36 UTC
My fellow brodas and sistas, I salute una. Abeg wetin we no go hear for this country as we dy so? Our presido com out say make we pray for the country as e be so, I no understand again. Nah any president wey enter sit go say make we dy always pray for country we them don use their hands spoil finish? Or them no know say people don start this prayer for long? If them dey chop the money them no go ask us to pray so how this prayer wan take help us? Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way? We go dy pray for better for the country them go dy make life hard for us, see dollar don climb skyscraper and I believe say some of us dy follow the raise of am so with all this things and some other Yama Yama wey dy go on for this country e still make sense as president talk say make we pray for the country? No be say e no good to pray but our presido need to remind us?

Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!

I don't even know what they are planning is it dey want us to pray for them to last on that seat or what? No be person wey chop dey get strength to pray, let assuming say we dey pray and we no see any changes to the country we be dey pray for, is like they want us to pray for their head too because i see say na waiting them deserve be that. Goods prices dey increase every day if person want to complain you go just hear say dollar price don rise say dollar don affect market, even person wey no know anything go say dollar don rise just to sell am for you at high price.

The only prayer that remain now is for us to survive this country over everything that come, fuel prices now is getting to where we no expect am, how much be gas per kgs now 1k for my side. The country sef no come dey safe waiting never happen for my side happened day before yesterday, bandits get mind enter person shop go kill am, I was just surprised where are we heading to because e just dey happen for the first time.