While we watch these videos and enjoy the entertainment part of it, some of the people pranked are left emotionally drained, some relationship/ couples trust has broken because they were pranked to check there faithfulness to each other and some people have lost so much useful information from there phone because a popular prankster smatched it on the ground and gives the victim a new one, not considering some important information in the phone that might be lost in the process.
You dey look the negative aspect while me I dey look am from the positive aspects as if dem lose their important information or other important contacts atleast dem go learn to dey get backup. Most phone has backup that you can back up information wey no dey sensitive to their server, dis one no be Bitcoin or finance things wey you no supposed store for centralized server but they're things like picture, videos and phone contacts wey you go store for your phone so you fit recover am when you get the new phone or buy a new one yourself. As for the other sensitive information, you support dey get a local storages for dem and na wetin I dey learn from this pranks video. Dey no dey funny but we dey in a society wey everybody dey claim freedom of everything without caring how e dey affect the other person so na for us to just protect ourselves.
Of course, some of these guys have landed themselves in trouble because they pranked the wrong person but others are yet to learn there lessons. Entertainment is not bad, as a matter of fact I enjoy watching them alot but when you ridicule or take advantage of the ignorance of others just to create your content, it becomes a problem.
I see news which day wey one prankster was shot and he almost lost his life outside the country, Nigerian pranksters get luck say gun isn't allowed legally here if not many of them for dun lose their life because we no get good health facilities for here and you know say police report is needed in most cases before hospital take your matter self. Another thing na for us not to take things seriously and just enjoy life, if your relationship break because of trust issue it means say dat relationship no be am. Why your partner no go show you love in all condition. Better the relationship end then e get more stronger and similar things happen in future then you later find out say you been dey date yourself all this while.