Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: As our economy dey so, Bitcoin na blessing to us?
by
Asiska02
on 13/10/2023, 21:50:57 UTC
⭐ Merited by hugeblack (2)
For me oh, I think say Bitcoin na blessing to us, because no single entity get control over Bitcoin.
Making it more resistance to censorship and manipulation.
E dey empower individual to get direct control over their finances without relying on intermediaries.

Bitcoin really come to us as a blessing wey we don already accept and dey use am, dos wey neva adopt am or dislike d use na their choice and d bitcoin itself na alternative to fiat current and not compulsory for all of us but e no dey limited to anybody. One tin I like with bitcoin be say e dey close that gap of not having complete ownership of your money to yourself and dis na one of d greatest thing wey make many us emulate am come dey use am. Me I no get any thing to say to dos wey know about am an no wan adopt the use, na their choice to make as dis bitcoin no be something wey dey forceful on anybody. Just let dem know wetin dem stand to get, d advantages and disadvantages of it when you don’t trade the good way, and dey will be persuaded or convinced to join willingly wen dey get and understand the whole concept.

The way our Naira de depreciate in value to USD always is something to think about, but the government no de even reason how dem go take rearrange am so dat the Naira go get value small, so if you been de save Naira for account, your money don lose value and u no go fit buy anything wey u been de hope say d money go buy for u before; but if you get bitcoin for your wallet, you no need to fear or panic because your money go de get value de go.

One good thing wey I see say we dey get as advantage to dey earn in bitcoin be say we fit dey convert am go USD and then from USD to naira. Anytime wey naira dey depreciate against USD, if we convert am we go get higher value in naira but to spend am again go come be like say we no really see any different from when d price been never depreciate like that. Anytime wey naira dey depreciate against USD, na economy downturn dey cause am, so that’s why the value of the money if you wan spend am go still dey the same. The good thing I see with earning in USD for Naija be say, you won’t see any different, whether increase or decrease in your source of income and spendings on a daily basis. Earning in dollar and spending in Naira in Nigeria is directly proportional to each other.