Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Cryptocurrency should be regulated not banned.
by
Hatchy
on 16/10/2023, 15:39:15 UTC
Also di harassments wey our youth wey de into crypto business de face for di hands of our law enforcement, like say na yahoo dem de into go stop.
that one na becos them they wan dey use bitcoin take cover up their evil deeds. if you wan know person wey get e money geniuely dem no dey show off say them get money even though say the money surplus. i no mean say you no fit buy better thing with your money, but youve got to stay on a low you know say them no dey use eye take look any young guy wey get funds so everything for this life na sense.

ok, back to the topic of dicussion. nija government no actually ban crytocurrency for nija, na cbn na e pass law say make bank dem stop any tansaction wey concern cryptocurrency for we country. but that one no stop we nigerians from using cryptocurrency atall. for long many people them don get the wrong idea about bitcoin and this one don cause the drawback of bitcoin adoption for we country. i no really know sha weather if them regulate bitcoin e go actually change anything. for me, nothing go still change.