My people ona good morning o. I no say dis news na old one but I say make we touchlight am small. Our x vice president professor yemi osibanjo on the 26 of February 2021 been say crypto currency no sopos ban for we country naija say we need to regulate am.
So now I come dey ask say if bitcoin get regulations for our country Naija, say we fit enjoy am as we dey enjoy like this?
Me no reason am say we go enjoy am d way we take dey enjoy am now oo. We really want make government adopt dis bitcoin but d same time I no sure whether we fit dey follow the rules wey dem go set for am once dem approve am. You too you know say anything wey government don put mouth for, dem go want make dem get full control of am and make dem get d maximum benefit from the thing. The way I dey see am ba, government go wan make am a means of sourcing for major revenue for d country and dem go to impose tax for people wey dey use am, and if e dey like dat, e fit discourage us wey don dey use am and people wey never still join go just lose interest for the thing. I just dey hope say anoda way go dey wey dem go still approve dis thing without given d tin strict rule wey we no fit take.
Or had it been say them regulate am instead of ban, them for gree make Bitcoin a means of transaction/payment?
If dem don regulate am and dem no gree make dem use am as a means of transaction for d country, how dem wan take dey get their tax collect wey dem go impose on the use. Oda tins fit dey come with the regulations o, but wetin I see say go be their priority na dat tax aspect and for dem to make am achievable we suppose dey use d currency for transactions of a daily basis. All dis things ba, no be something wey go really give dem tough time to make am happen but dey gatz put some kind things down and into consideration wey go benefit both parties but theirs is of more priority. Just know say as bitcoin still remain decentralised, d tendency of government approving and making it a legal tender is still slim.