Every body wan make quick quick Cash .Gone are the days when youths work hard to earn a living,them no send how the money take come..nai make now scammers full everywhere...nobody is safe . Government too is to be blamed Sha cuz if you go all these government offices no workers yet they won't employ fresh graduates .Na only God go help us
The rot start from the top down to the bottom... everybody dey hustle to make am against all odds. Check how far our politicians are ready to go just to be in power. That is what is propelling the youths to do both legal and illegal just to make am. Many people dey even before them make am but the hustle continues.
I no really dey against working hard to make am, I no dey against fast hustle... wetin I dey against na quick money through illegal. Any money wey no give us rest or wey we get at the expense of other people blood or tears no really make brain.
Best na to remain clean dey push life small small dey go. If you find anything wey genuine, come dey put food for your table, abeg give am your best.