Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Quick money wahala
by
Broadanbig
on 26/10/2023, 15:23:11 UTC
OP for this country wey we dey so things no align well at all. Government dey one corner dey do their own, politicians dey the other corner dey milk dry the treasury of the nation, how the citizens want to cope na. Even when you get the business idea wey the capital to take start am even if you see investors dem go dey doubt you and some times dem go want to take lion share of your profit wey no make sense. If government decides to give out loan, dem go share am amongst themselves without any fear and dem no send you as na money wey dey involved.

Wetin dey left for the ordinary country man and woman na to hustle their ways to the top. Legal or illegal man must survive naim be the anthem of the masses now so tey dem no care the consequences of wetin dem dey do as long as the end result go fetch them money,  Na wetin make this country dey as e be so wey e be like say things just dey happen anyhow as e regards, stealing, killing, kidnapping etc.