Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Quick money wahala
by
Gozie51
on 27/10/2023, 07:06:23 UTC

Government to be blame wella, the truth be say since the country began to be hard in search of job the country na the rate of all this using people for ritual increase. If governments was doing well for it citizens the level at which people do criminal activities I don't think we will at this point where we found ourselves today . The government is to be blame and the family where we come because sometimes family put much pressure on people to make it. Society pressure is the reason why all this things are taking place, broke shaming people because they don't have money to live expensive life.

My brother for me I go blame the government for all the things wey dey happen for the country and all the things wey don go wrong. When I even say government, na the number one man e fall for him head whether president oo, governor oo because na dem dey in charge and dey receive all the information whether good or bad wey dey happen for the country and so wetin dem carry the information do na im matter. For example, you no go say make people dey manage while you dey enjoy and thief money with people wey dey work for the government. You no go give order to sentence offenders wey dey close to you on their corruption offenses.

Na government dey shape some families, things hard in midst of plenty and so people go still do things to survive. If government dey responsible then the people go dey responsible.