Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Topic OP
Educating Nigerians about Bitcoin
by
Miles2006
on 30/10/2023, 20:58:28 UTC
⭐ Merited by hugeblack (2)
As I started my bitcoin journey last month I observe say bitcoin knowledge is very backward in the country and bitcoin knowledge na wetin everybody go fit acquire in a simple way. According to wetin Satoshi Nakamoto talk bitcoin is for everyone and people who become part of the technology, and that's why I'm using p2p. I come dey wonder for naija way we so I no know for your area but for my area i no too dey hear bitcoin, the thing no dey popular for my area. Most people never hear the word bitcoin for their life self, so how we go do?
Last time I wrote about a topic will Nigerians marketers accept bitcoin if legalize. I saw different comments say them go accept, but to accept bitcoin no be the problem, them get the knowledge about bitcoin? Because wetin person no know big pass am by far. People need to get a solid knowledge about bitcoin first before using it and how to secure their coins/wallet if possible make them get guide wey go guide them through because if bitcoin dey legalize for naija scammers go dey invent new methods every day just like the way scammers dey for fiat.
In essence I wan talk say make we dey teach about bitcoin for our area because as bitcoin dey grow so countries go make bitcoin dey legalize as the world dey develop with different technology and Nigeria no go dey left behind, I believe say Nigeria go make bitcoin as their legal tender one day. So make we start to dey teach the knowledge about bitcoin so that the thing no go dey new for people ear.
  • students/children I have seen many threads on children education and I also want to contribute my view, one thing I observe about children them dey very sharp when it comes to learning especially learning about technology. I go like say make we start to dey teach the younger ones about cryptocurrency(bitcoin). Teaching them about the advantages and disadvantages about bitcoin, the risk involve and everything wey person suppose know about bitcoin. Some go say wetin concern small pikin and bitcoin, so as long as the pikin don know good or bad that pikin fit learn about bitcoin, so creating the awareness of bitcoin to our children is one of the best idea.
    Here are some threads about educating children about bitcoin:
     https://bitcointalk.org/index.php?topic=5438924.0
    https://bitcointalk.org/index.php?topic=5432314.0
    https://bitcointalk.org/index.php?topic=5454984.160
  • business owners: I think if you're a business owner maybe you're into selling of goods, clothes or supermakert, is best if you accept bitcoin as your pay in return. By so doing you're creating the awareness of bitcoin to your customers for example a school principal accepting crypto (bitcoin) as a school fees payment, he also stated that he believe that one day digital money will gain more acceptance than paper money so he wants to be part of the technology now.https://cointelegraph.com/news/nigerian-secondary-school-will-accept-crypto-payments-despite-regulatory-uncertainty
Lastly bloggers, if you dey into blogging, make your site dey talk about cryptocurrency(bitcoin), cause everyone makes use of the internet everyday.