Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Educating Nigerians about Bitcoin
by
knowngunman
on 31/10/2023, 05:24:53 UTC
Na true you talk but you start your journey bitcoin journey last month and you think you don get enough knowledge about bitcoin to dey teach people? My brother bitcoin big pass wetin you dey think and you sef need to continue learning before you think of creating awareness. Make both you and your students no mislead each other. Creating awareness about bitcoin na good thing actually but you need dey careful for your own safety. Na Nigeria wey dey and you know wetin that one mean na. Forget say people no dey talk about am for public, some people sabi am pass you bro.

You no need tell everyone to come learn bitcoin before you go become victim of attack. Unless na very remote area you dey because if na town everybody eyes don clear and even people wey no dey do anything bitcoin know say money dey and when you begin shout am now na to organize attack for you because dem go think say you hold bar (money). I go like advice you to observe the kind area wey you dey first and the type of people wey dey there before begin reason dem with bitcoin matter.