There are several reasons why people smoke and the reason is best known to them and I no wan condemn anyone as I already know say reasons differ but still smoking for the sake of wiping away poverty or brokenness isn't a tangible excuse for smoking especially cigarettes but I think I've read about some health benefits of Marijuana which is mostly consumed by the youths a d I learnt it also helps to reduce depression and I think you can research more about some health benefits of Marijuana and cannabis and I believe say we no go really condemn this weed we dey condemn like this.
To add to wetin you yawn, people wey dey smoke don talk say weed dey make Dem reason well. I remember when dem interview mountain black and mad melon, nothing wey you no go hear about how weed take good and dey help give dem inspiration. Some weeders don also talk say e dey help dem sleep without hangover the next day and say e dey make Dem eat wella. Them say wetin make people dey misbehave and cause trouble when dem take am be say dem no dey eat and if you no eat, the thing dey worry the brain well well and if care is not taken the person go enter kolo levels.
However, that of ciga, me I never hear of any health benefit for that one if no be say your lips go dey black and your lungs too go dey affected according to wetin we don read about the effect of cigarettes smoking.