Op you don do well to bring this kind of important topic for us to discuss, the knowledge of bitcoin suppose spread for everywhere for we country so that even the government go no say em citizens dem take am serious, because I believe naija, any thing wey we love must trend all over the country even the world if possible, and if bitcoin knowledge trend well well for the country, e go be like say we push our government for thight corner to make legal decision to remove the restriction. Mr knowngunman I no too blame you because of the way you attack the op, for area wey I dey stay if you ask person about Bitcoin dem go tell you say na something wey if you put N1000 e go grow within short period of time to N10,000. Dem think say Bitcoin be like those normal ponzi scheme dem wey dey grow money then crash after a while, false information of Bitcoin naim dey trend for my area even when you try to educate person wey don make up em mind e nor dey easy for the person wey dey do the talking/teaching.