My broda fraud dey everywhere and I know why people wey dey this naija dey always think say Nigeria nai do fraud pass. For my thinking, I actually think the motive that first lead to Bitcoin being ban, no be even the issue of fraud because I believe say the matter dey related to the fact say these government dem no fit track and tax the use of Bitcoin in the nation since at that time the technology was still new to them but with recent development the new government seems to be kinda creative when it's comes to matter of such.
No be lie my broda, that thing call fraud dey everywhere but you see this Bitcoin, e make am hard to know who dey obtain you. If person chop you mugu through bank account, at least you fit know the name wey you go carry go ogu or Shiloh. But how you can take call Bitcoin wallet for prayer? E no easy my brother.
Make we for dey use sense dey follow things for Internet o, fraudster plenty everywhere and everyday na different formats them dey carry come.