Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: This idea go reduce our daily expenses.
by
HajiBagi
on 06/11/2023, 15:09:18 UTC


My brother this bike fine and e dey economical also and if you check the price too e dey fair. I no know which country you wan order from and the importation fees. My major  challenge for this bike be say e fit make you dey stranded because the battery wey you charge fit finish unexpectedly for middle of road. Just like if petrol finish you go enter filling station. But for charging, e fit hard because normally light sef no dey Nigeria like that.
If you look am you go under say the country dey connected for suffering. Light sef no dey, petrol come expensive and people are looking upto gass now.


Ehhnen na waiting I be wan talk you just talk so,although the bike good and he dey very well wey be say you fit buy but if you take look at this our country now light is one of our problems and the light matter sef lead to the process wey be say another country wan give us light, if we buy that bike now how we go take charge am abi person fit use generator charge am too, as the bike dey so if person wan charge am again you fit use more than 24 hours charge before E fit get better charge wey go hold am tight wey go make am move very well, because as I dey even see the bike like this E fit mess up if person dey go somewhere or the thing fit go stop for road, but thank God say the thing no even heavy like that Grin.

And again I don't think the bike fit go places wey too far like that, like when person is going to travel to somewhere, the only place wey I think say person fit go with am be say make person just dey waka with am up and down for town if not if anybody try to carry this thing go long journey I swear that person Don suffer because the person go know the different between fuel and charge Grin, no be say I dey try spoil the matter oo, but we should also know that everything get advantage and disadvantage.