My people I greet una o, As our people say person wey ask for road direction no dey lost and as I no wan lost and be left behind na em I say make I ask small questions for directions.
I've often seen posts that says a newbie should read more and I've been doing just that, I don read, read, read sotey my eye dey turn me. But what is a student without a teacher? Make senior men Dem for here help me out with replies wey go butter my bread, make I know if I dey on the right track. I've been reading and going through posts of legends to learn how to make quality post as required of me but how do I learn if I don't get feedbacks to know if am doing the right thing?
And talking about spamming and plagiarism, how do I know if the post am about to post has been posted here before?
Una say as a newbie make person dey ask questions, I don ask my own o, and I hope it makes sense. I just need some help to grow.
You dey welcome to di local board and weti you do e make sense. And now that you have read, it is time to understand what you have read and ask questions base on what you read. This one won wey create sef e good but na from general knowledge from the reading. So u have to ask on the area wey you no understand from the reading and when other people wey understand the question respond to you and u come understand weti dem tell you then learning don start be dat. And to know whether di thread has been created. Na very simple something, as oda people don tok am. You just type di topic in Google search bar plus Bitcointalk.org. example. Newbie alert, my people I need help to know more about this platform. in Bitcointalk.org and you click search then all the topics related to that topic will appear and if there is non then you create yours.
Talking about to grow. Read and make contributions which is of quality. Merit go come if you dey post quality post. Even in dis local board you go get merit Wella.