Every body wan make quick quick Cash .Gone are the days when youths work hard to earn a living,them no send how the money take come..nai make now scammers full everywhere...nobody is safe . Government too is to be blamed Sha cuz if you go all these government offices no workers yet they won't employ fresh graduates .Na only God go help us
Everybody now wan dey leave expensive life, people wan leave flashy life and nobody wan do legit work, because that one no go quick money na why everybody na scam dey just dey jump into, d once wey no go do scam go do money ritual, some of them no care even if na 2 years dem go spend for dis life if dem do d ritual before dem die, dey go still run am. Wetin dey make some people dey do those illegal things na pear pressure, if friends don dey buy big cars, dey go party and dey buy expensive cars, some of them no go get choice than to do Wetin there friends dey do.
We know say we get bad government wey no care about d citizens, what politicians know no pass make dem steal money, things are getting hard in the country, but me I go still talk say that one no mean say make u go dey do illegal things, excuse no dey for doing bad things, people dey wey dey suffer pass u and dem no dey do illegal things, things dey wey u go fit dey do for survival, but u no go expect big money from those things, but our youth no wan do things like that. Even as d government no dey try, e no mean say we suppose dey involve ourselves for illegal things, yahoo boys don spoil reputation of dis country for outside.