Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Newbie alert, my people I need help to know more about this platform.
by
Cityhunter34
on 09/11/2023, 15:54:00 UTC
My people I greet una o, As our people say person wey ask for road direction no dey lost and as I no wan lost and be left behind na em I say make I ask small questions for directions.

I've often seen posts that says a newbie should read more and I've been doing just that, I don read, read, read sotey my eye dey turn me. But what is a student without a teacher? Make senior men Dem for here help me out with replies wey go butter my bread, make I know if I dey on the right track. I've been reading and going through posts of legends to learn how to make quality post as required of me but how do I learn if I don't get feedbacks to know if am doing the right thing?

And talking about spamming and plagiarism, how do I know if the post am about to post has been posted here before?

Una say as a newbie make person dey ask questions, I don ask my own o, and I hope it makes sense. I just need some help to grow.

Op na the right place wey you come so to ask help from our baba, wen I read reach where you say you don read until your eye don dey turn you, I first weak because I understand your pain, na exactly wattin I pass through as I join this forum new, make I no lie, e nor easy at all to dey read about 23 posts before you reply though person fit short cut oo but e nor too good, if person really wan grow em account  for this forum the only way out na to love reading because na the only way be that. As I dey like this people around me don dey complain say my phone and laptop nor dey gree commot for my eye, and na true because I get goal to achieve, I gats learn enough na for my own benefit no be for other alone.

So I go encourage you make you no give up, provided say you know wattin carry you come, make that thought dey ring for your head. Concerning the spamming and plagiarism matter, you fit make use of the search button to take know weda person don write the same thing before.
https://talkimg.com/images/2023/11/02/tSCQq.png
Though for the search e dey very wide and confusing most times buy na the only remedy wey I get be that maybe our boss dem fit get another alternative wey dem dey use. If you check loycev post for meta about to report plagiarism you go also see the wey dem take dey catch plagiarist, them dey use some online plagiarism detector take dey find those people wey dey do plagiarism, so on the other hand if you dey suspect your post to fit get some plagiarism content you fit just try am out with those site to confirm before you post am for here.
This na the one wey I know when dey work well:
Quetext.com
Thank you my brother, you don talk wetin motivate me the more, as you say you don go through wetin I dey go through now e really means a lot to me, you just needed more grease to my elbow to keep pushing.