Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Newbie alert, my people I need help to know more about this platform.
by
Smartvirus
on 09/11/2023, 16:55:56 UTC
And talking about spamming and plagiarism, how do I know if the post am about to post has been posted here before?

Una say as a newbie make person dey ask questions, I don ask my own o, and I hope it makes sense. I just need some help to grow.
The both way you write here being “Spamming and Plagiarism” na international act, no be watin person no Dey know before e commit am. The thing be say, we from a part of the world way be say, most of these no Dey actioned so, e con make we no too Dey conscious of the act.
Spamming no Dey accepted not just on the forum but, the plenty forums out there and where literally works are being taken into account.

No be lie say person way ask question no dey miss road. One thing way dey preached here be say, make beginners try dey search out some topics before them create new one. The matter here be say, forum search function no go carry watin you Dey search paste for you in exact but, you fit read from the many options way them paste for you and see related threads on watin you Dey fine, from there you got get your answer.

Meanwhile, if I ho advice you on way forward, I no go say make you try to sabi everything one time but, approach am gradually and allow watin you Dey try learn sink in before you jump to the next.