Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: How ona dey cope for 9ja noisy environment?
by
Youngkhngdiddy
on 10/11/2023, 22:47:11 UTC
my brother i don dey addicted with noisy evnviroment ooo because were i come from, for inside house na distraction and for outside again na distraction the first time we pack into that enviroment i was like this people are too noisy but for just some days i gaz cope with the enviroment because sometimes for inside house e go wahala between husband and wife and sometimes e go be between father and childrens .

   Nigeria normally is filled with noise. We begin the day with noise and end it with noise.The atmosphere breathes out noise. Areas dey wey dey serene no doubt buh 90% of the country is noise. Just imagine place like Lagos, there's a reason why Dem call am city wey no dey sleep; even around 1am people still dey run dey run business not to talk of the bus parks d place they always day busy 24/7 you go wake up with noise for morning still come for night generator from your neighbor fit wan tear your ear. 
   These noises dey cause heat and pollution too. The environment no fit dey conducive with the noise wey dey. Nothing wey anybody fit do about am, na to jus live with the noise and then find fun in it too. Na the scope of survival be that. The good thing be say, the noise no jus dey disturb buh e dey help keep the country lively too.