Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Hardwork no longer incur success
by
Jegileman
on 11/11/2023, 08:18:59 UTC
Some examples of smart ways to make money are;
be social and make good friends who you can grow with. The information you have can determine if you will have money or not, try get friends wey una dey talk better things like how to make more money.
Do your research then invest in where others dey invest. People dey invest in bitcoins, invest in bitcoins.

Share some other smart ways to make money.

All dis things wey you talk now OP, I swear you no lie and na d facts be dat. As I be like dis now sef, I no dey really like work wey go make me dey comot for house early in d morning, bath, dress up, come follow road dey meet traffic and noise pollution everywhere wey I suppose dey rest or do some other things for house. Working from home na him be d best now, all d people wey dey mostly make am today na through internet and working from home. I no really send government now because na stress. The only benefit wey you fit get there na pension after you retire, all d rest na so so sufferness and dem no go still pay you well. I no still mind getting one but I go prefer to dey work from home and invest some money on some physical business if e go dey profitable for me.