But I hear say na Davido pay di bill for everyone that dey ow MTN because im win award. Some came to my side and told me di Tori and when I checked my account, I come see say n true true dem don clear my #500 debt. But I never really believed say na Davido go pay day money because dat money go reach trillions. All di households in dis country dey ow MTN and the minimum go be #50 and above.
Na better thing wey Dem do oh but I still dey suspect dem. If na MTN really remove all dis people their debt from di database then something is better e don happened to dem and dem no wan tell us. MTN I know e no go just clear people loan like that. Dem too like money. Don't worry we go hear di story very soon.
Thanks for dis update about how you reason say di matter be on why mtn clear dem customers recharge dept. Di OP no tell us di kind loan or give us details about how dem take clear di loan, whether na recharge card loan, bank loan or mtn agents just enter dem area de meet everybody de ask dem who dem de indepted to, and clear di dept. Abeg e de very important to at least try to de give more details about events wey we wan take start topic, so people go get idea of wetin dem de talk about to know how dem wan take chuk mouth for di matter.
I hope say mtn go come out and officially tell us why dem clear di recharge dept for people wey de owe sem.