This Nigeria dey really tire me as na we dey make things hard when like normally no suppose hard and I no know which side of the country you dey but bro make we rest abeg because the same us na e still complain about the rain and I been don talk am earlier when this rain dey do do, I been just know say na so sun go also shine too because meh, the rain been fall badly this period and I also know say the sun go also shine badly so make we no dey in a haste to dey complain.
I go advice you make you try buy face cap or even umbrella and get ready for the sun mate 😂😂😂
My brother i think say na only me dey experience that thing for were i dey ooo, nija sun no be for here ooo especially this sokoto were i dey wey be desert area the sun wey we dey experience for here fit fry yam i dey tell you but me that i have face cap i don use to complain the wey the remaining people do, and in time of rainy season we don use to have excess of rain here.
So if i am you i will just go for face cap, but i don't no your power but for me that can not afford umbrella i only go for face cap.