Overtime i see that whenever there is a dip in the price of bitcoin, other altcoins tends to follow suit by also dropping in their prices and whenever there is an increase in the price of bitcoin, other coin as well increase in their value.
Just as baba cryptopreneurBrainboss don talk, bitcoin naim be their master and anything wey master naim boy go do oo, if the boy go go pass em master e mean say em don dey grow wings and 70% of the time the boy no dey fly dey go anywhere. Likewise crypto we no go fit get two masters for one place, so one must lead and the other go follow if not na so so problem go dey until dem settle that matter.
One of the greatest reason why altcoins price dey tend to follow Bitcoin price na because, most altcoins dem no go fit buy dem with fiat currency so before you go buy dem you gats first buy bitcoin den convert am to the altcoins and when you wan still sell am you go still convert am to bitcoin before you fit sell am, so e just be like say na Bitcoin dem dey take do every thing wey concern those altcoins, and for normal sense na Bitcoin price dem take dey measure the price of those altcoins no be even dollar.