Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 5 from 4 users
Topic OP
The fall of shitcoin/altcoin, the rise of bitcoin
by
Pi-network314159
on 14/11/2023, 19:20:56 UTC
⭐ Merited by Moreno233 (2) ,CryptopreneurBrainboss (1) ,Hatchy (1) ,Uhwuchukwu53 (1)
I greet ona o. I just dey reason how many coin don surface for air after bitcoin. So many of them don fall finish. If you go coingecho or any crypto website, you go see say na everyday coin dey enter market and naso them get short life spam. People wey never know wetting the happen go dey buy am dey Happy say there future don bright not knowing say na junk then they buy. Tera Luna and FTT coin show people shegge and other ones wey I no no. Now people come dey realise say na bitcoin be the Koko. So I come they think wether na these things wey happen to people naim increase bitcoin adoption pass the way e been dey before or bitcoin for just grow without these things wey I talk.

Abeg make ona shear ona idea on wetting ona think dey increase bitcoin adoption