Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Why Nigerians value burial ceremony more than other occasions?
by
Gozie51
on 14/11/2023, 21:03:13 UTC

I go say make we try imbibe the white man's ways in things like this no be only to dey copy bad things from them...Una Weldon

This is more rhetoric than wetin you want try raise for your post. You suppose know say no be no be all Nigerians dey do that burial thing and you don generalize am. You know say na mostly the christian communities dey do that and Dem dey see am as giving a "befitting burial".

 When people contribute to the dead dem dey feel say na last respect, at least dem no go get anything to contribute for the person again and culture and tradition follow join.

You know say Muslim no dey do like that, especially core Muslim and northern Muslim.