When you check you will see that bitcoin price is rising day and night and what price do you think that will be maximum price of bitcoin this year and before we enters 2024, and again what will you advice people to do as the price of bitcoin is increasing.
Where Bitcoin wan fall go again, even though e fall, chances dey say e go increase as halving dey come so oh so if you go dey procrastinate na yourself wey you dey do because Bitcoin go continues dey increase. The time wey Bitcoin been dey low dun pass, like dis we dun dey commot the bear market so na up up wey Bitcoin go soon start dey go. Halving na just next year and people dey rush dey buy and hodl because dem know how e dey be during the bull market. If person wan invest no pursue am say make him come back when market go dey low but help am make him invest but teach am things wey him go need know as Bitcoin investment nobi wetin you go put money wey you go need urgently inside. Make him just invest small amount and hodl like others. If the market fall na luck for ham and make him buy more but no go dey wait for market to fall before you buy.
Timing the market and trying to predict price movements is challenging, so it's best to consider a long-term investment approach rather than trying to time short-term price fluctuations.
Timing na for traders na and since no be trading wey dem or you wan do you no need am. Smart investors no dey wait to buy, dem dey buy to wait. An investor buys to hodl, if you dey observe all those big whales dem wey dey the industry. Na so so buying and Hodling wey dem dey do and also DCA as dem dey Invest when the market get any big dip. If we dey follow wetin dis guys dem dey do we no go dey lose for the industry but you dey see all this timing of buying and selling e dey give us the wrong mindset. If you buy when the market dey down and hold to sell for future, you no need timing when to sell because anytime wey you sell na better profits you go dey make so.