Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Reason you still invest in BTC
by
CryptopreneurBrainboss
on 16/11/2023, 06:21:09 UTC
How many of you guys  entered at this current point

No doubt you guys should be smiling by now

Rhetorically why aren't you into BTC  Roll Eyes. This is even enough for you for you to get in before it pumps.

E dey hard to catch the bottom of the market, make e no surprise you say na exchange bots na wetin buy at those prices wey you dey see so (a majority of exchanges get bot wey dey make their platforms dey active by creating small buy and sell orders to make it look like there are active traders on their exchange every second of the day). The exact entering point no matter because even though you been enter few dollars after the bottom like for $20k or so you go still dey inside profits. No just use the profits of Bitcoin rush give people's advise to buy Bitcoin. If you do like dat, then get ready to receive the blame when the market no favor them. Also you dey the wrong platforms because many (if not all of us) here are already invested in the market and that's why we're here. Maybe we fit no dey buy Bitcoin directly but we dey earn am here.

But truly oo the way bitcoin price take dey run go up lately even as people last two months ago don predict say the price go crash back go 15k still dey surprise me because normally the price dey drag towards the year before halving or e go kuku crash. At least we remember the crash wey happen for 2019 wey price touch around 3,500 before halving for 2020. But this year price just dey go up and next year na halving, this signify say market go sweet next year and 2025. Buy hodl hodl and hodl.

Belike you make mistakes oh because I remember say na COVID-19 year na when Bitcoin crash that low. Also remember when everybody been dey talk say Bitcoin go cross $100k for 2021 during the bull market but e no do like that. Also remember people been dey think say 2021 bull market go dey like 2017 bull market wey get the last leg run for the last quarter of the year but e no be like dat. Wetin I dey try reasons you na say the market get him own mind, e no dey do wetin people dey think but wetin e feel like doing so next year fit come and Bitcoin no rise like that so make we get that one at the back of our mind too since the market just dey do anyhow this days.