My country pipo e go really make sense if you wey they seek for admission into the university learn at least skill wey fit fetch you income the reason why some of us find am hard in school na because we no learn handwork (skill) so the thing come become very difficult to even concentrate properly some days wey nothing day no food no money to go class go worry you and all this things really dey discourage somebody well well, those wey learn handwork before gaining admission into the university no really face much difficulty because them get service to render in exchange for cash aside ur schooling e dey very important to learn handwork before u enter school because that time your brain still dey young and not much responsibility to think of unlike when you finish school to come learn some settings kind of handwork that time go dey very very hard because you done dey think about your responsibility at hand and that time u fit no get chance unlike now wey you still dey mama and papa house this na my own experience and my regret.
I think now most parents eyes don open ,,my area now as soon as pikin write waec Dem don go register him or her to learn one hand work or the other... because the way the society don be now especially our country here na hand work and business people take dey survive. Me sef get my own regret of not learning one but I go correct that mistake in the life of my children. Na so me I see this matter