Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
by
Samlucky O
on 17/11/2023, 02:54:49 UTC
This matter you bring for here na true Matter. For person to succeed for 9ja you must dey Versatile. You go must they sharp to adapt to any new latest update. But no be the wrong one o. But you know what? the thing wey go make you rich they always dey common for person eye. If them tell me say something wey dey like this forum dey I no go gree. Because people mindset don curupt say anything wey dey bring steady money online na Yahoo. The person wey introduce me to this place because of his achievements sofa people don concluded say na Yahoo him dey do. At a point I nearly believe until him come initiate me for this him Yahoo wey be this forum. Before my doubt come clear about that.

That's why wey dey always pray say make oluwa help us locate our destiny helper. Because no matter how hard working you dey or how many handwork you get if your destiny helper never locate you, all those things wey person learn fit no put beter food for person mouth, or probably no ft give you as much as expected.