Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Importance of learning a skill before gaining admission into the universIty
by
CryptopreneurBrainboss
on 18/11/2023, 03:55:07 UTC
My country pipo e go really make sense if you wey they seek for admission into the university learn at least skill wey fit fetch you income the reason why some of us find am hard in school na because we no learn handwork (skill) so the thing come become very difficult to even concentrate properly some days wey nothing day no food no money to go class go worry you and all this things really dey discourage somebody well well,

Truth dey inside wetin you dun talk because when you get handwork, e go make you dey independent and you no go dey worry you family people and dem fit concentrate for other siblings to train them for school. Skills go make you dey above your pairs as una finish school. Skills go make you fit handle some kind challenges wey school for Nigeria dey get wey involve money and overall e make sense to dey get your own funds but no forget say anything wey get advantage get e own disadvantages. As you dun get skills like dis and dun dey hustle for bread, your attention go dey divided. You no fit concentrate for school again as all your mind go dey divided and e go dey tell you say school na scam and wetin you dey suffer yourself dey go school when you dey already make money from your skills. You go wan focus on the skills and this one go affect your learning.

If you be A student, you go surely drop down to B student because e go hard to juggle between hustle and schooling especially if the skills na manual one but if you get soft skills like trading or other online hustle wey be say you fit just dey your house dey do then E go better than the manual ones and na that kind skills me go advise anybody wey still dey school for here to do. Like this forum wey dey paid, you fit dey use am dey support yourself as writing here no go take you much time if you plan yourself well but in all no totally depend on school because if you waste all those 4/5 years for university and you no achieve anything, work no dey outside oh.