Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Is Nigeria a failed project ?
by
Youngkhngdiddy
on 18/11/2023, 14:47:54 UTC
Weather Nigeria na failed or unfailled project still no change the fact say we all be Nigerians and we dey part of am cos e dey our hands to decide wetin good for us. See our last Election, see the rigging and everything but still yet we no fit do anything to change am, no be to fly up and down dey go court omor I believe say e don burst pass dat level, even scripture go talk say from the days of old the kingdom sufferet violence and the violent once go take am by force. You can't tell me say one man because him feel say him get money go just come rub sand for our eyes, e no supposed be like dat Nigerians has enough multitude to pull am out from there, na just to remove religious diversity come together and kwa I believe say before we go see change for the country e suppose start from personal, Angel no go come down come rule wey go make the country better
    Nigeria my country, sometimes to talk about the country dey tiring because no matter how much we brainstorm for its betterment, it just can't get better, it even keeps getting worse. Everyday we wake up to crazy news that in a normal world setting it's incomprehensible and impossible but naija don make am possible... Like how??? E jus be like say everybody dey trapped in pre hell, nothing is heard, no voice that yells is listened to, we're in our own punishment and we don't know how to get out.
    The old guys don too jonz us. I really wish say unity fit dey and contentment because why people wey join hand to protest against bad governance con turn back against the people wey d thing dey hear more , then betray them because of greed? E jus be like say na only some certain people this country dey benefit and e no dey pass the circle. Na this kain thing dey cause unending sporty bet and yahoo, even crypto trading but the wicked hearted leaders no go gree boys get peace of mind. EFCC no go waste time raid boys wey dey try make end meet but Dem go investigate who be real thief so calmly. The country is a mess for now and e be like the mess go long.