Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Imagine wetin we fit use BITCOIN do
by
rachael9385
on 18/11/2023, 20:36:58 UTC
Wahala dey for this our country too planty if them go alow us use bitcoin do waiting we won use am do we for do done beta by now self, things for less for us well well. Oya just imagine am say we fit use BTC pay house rent, transportation, buy car, even use am marry wife from obodoyibo e for make sense.. But our government no go gree us use am because say make them dey see money chop from us. But e go still hard for some of us too. because no be everytime BTC dey do well and no be everybody sabi how the BTC market dey be.
If the government allows the fiat banks to dey carry out crypto currency transactions, things no go completely better but one of the good thing be say e go make our money dey under our own care because plenty pipo no go use the fiat bank again and this nah one of the major things way the government dem them fear nai make them restrict the bank to dey run crypto currency transaction.
If our government them legalize Bitcoin fir this we country, e go dey more easier for us to purchase Bitcoin directly from our fiat bank account and still we go get more privacy if we just put our funds for safe crypto wallets.