My experience so far on this forum is great, I have come to understand if you follow forum rules you'll be fine and when it comes to merits just keep on producing quality post in the best way you can and in no time the merits will start coming in their numbers.
Hoping to hear from you guys soon.
Username: Gormicsta
Gender: Male
Skill: Anything wey concern to build and develop Website.
First of all I wan Hail you as Boss wey you be for his thread wey open here to give we the newbies the opportunity to speak out make una wey be the Ogas hear our voice too, make we pour out our mind where e press us for this forum wey join so that una wey don pass this level wey we dey so now go know how una go take help us to make our experience here easy for us. Many people no know am but na big thing una do for us so.
Me na Port Harcourt Blood and although I been don join this forum before years ago but I don forget the log in details to my old account wey make me register this new one. As I come back just few months ago come see say our Country don get e own Board, walahi e sweet me enter belle and this night wey I just checkmate this our Local Board now come see this introductory thread, na e I rush sharp sharp to come introduce myself too make my face for show and make my shoe for shine too for the board.
Once again thank you for the small advice wey you just give us for here, I believe say as newbies e go really help us, although plenty of us wey be newbie feel say the primary objective for this forum na to make merits, sure to make merit goes well, but with my small stay for this forum I don figure out say the primary objective here na to gain the knowledge first, and when you don dey get the knowledge you go find out say to make quality posts go be less for you and just like you talk, the merit go dey come steady. Once again we appreciate for this opportunity una give us.