Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: This idea go reduce our daily expenses.
by
Pi-network314159
on 21/11/2023, 10:51:10 UTC
Good day my country people I come with another good idea way go make use spend lesser for this hard time way everything just dey cost like say tomorrow no dey, this period way fuel cost e make transport self add money so I go like share this good idea way go make us no spend too much.
This one nah electric bike

Just this morning I watched one video for social media way one guy dey advertise electric bikes and I con like the thing way the guy dey talk about so I say make I carry am come this our local board for this forum because nah only us nai know how e take dey for our country.
This electric bike we fit carry am go work, strolling and even go markets to buy something's, you fit still even use some carry somebody and e dey easy to drive just like the way gasoline motorcycle dey, now way the price of fuel dey up if we get am e go reduce our expenses small nah just to charge the electric bike that's all but you go need engine oil, but that one nah once in a while, I see the one of $300 and I try to order am online
Just some days ago wey I just dey reason this matter consedring the rate which fuel they cost and how people dey manage to hardly survive, so I com they reason about to buy rechargable byk wey fit reduce the rate of expenses. I no even know say these topic don already dey here. I come also get second thought about  am because another  disadvantage wey dey dere na lack of electricity or low power supply. We no get steady light and e go affect for charging just like @brainboss talk. If to say na Sola rechargable byk e for better because Nigeria dey always get heavy sun so as you dey ride am dey go na so e dey recharge am. Another thing too na durability. how long e go fit last or the distance e fit cover because checking the price tag of this machine as of them, maybe by now e go don cost now. And e no go good make person go buy wetting no go fit carry person go far distance.
And I dey reason say our government no go too put body for the impotation of this machine because them go see am as threat to there market. For those wet dey impoet petrol machine. Because them go see am say if machine wey no dey use petrol come out people no go buy there own product.