Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party, pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people. Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street, you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
make i shock you say some persons no be say dem dey form, na just their normal lifestyle to dey select food even though say them never eat anything, dem prefer to stay hungry than to eat wattin dem no like, but the one wey pain me pass na those people wey their ogah give them car to go wash but dem go come end up using the car go flex and most times this flexing dey sabi purge dem, maybe the car go come get issue or get scratch and before you go know dem don loss the job wey dem dey manage. then concerning the cloths own i get one friend wey sabi live this kind of fake life, em go fit borrow both top and trouser like 5 from different persons take do fine boy. but i wan still clear your doubt say no be only naija this kind of things dey go on, na every where e dey most especially for this part of Africa.
Make i suprise you bro,na for naija you go see 2 guys wey they share the same dress just to impress people, na only god knows why em no give some people money for naija if not this country will have been worster than how it is now because the of kind life wey some of them wan live for this our naija no be small thing, the one wey they pain me pass na em be say some of them sef no go wan do waiting there power reach na em even make stealing plenty for our naija now.