Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party, pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people. Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
I no sabi Wetin people dey get from that fake life wey dem dey leave, you no get something, y u go come dey pretend, but I know say Wetin dey make guys dey do that one na mostly because of women, but d most surprising part is how people dey fit maintain that kin life. And mostly girls dey leave that kin life so that if guys see dem, guys go dey reason say na big girl them be, and some dey do am just to make their friends feel jealous, but na rubbish me I see things like dis as. I dey hear am say dem dey rent even complete building for Abuja for like one day, and even cars dem dey rent. If you just wan impress girl you fit just rent house and car for one day, if d girl come she go think say na u get am, but na rubbish all those things be jare.