Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Fake life in naija
by
DaNNy001
on 21/11/2023, 23:28:56 UTC
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
The feeling to be among the elite social groups is not only common in Nigeria alone, my brother this habit sometimes na due to peer pressure influence and many youth of this age dey always fall to am. Fake life dey always cast and it's not necessary because instead of living a pretentious life, try struggling and living your life as simple as you can and go on with flow and Wait for your turn to come.