Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party, pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people. Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street, you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
you done hear the phrase "fake it until you become it?" Baba, some people de fake am so when de finally get the money e no go had them to live the kind of life them been done de fake. If na just to borrow car or cloth burst out event, I no too reason am as any big deal because even the oyibo when we de learn most things from de also buy car and with time de go de pay am small small. E De only get to me when I see person when no get shishi for account de form unnecessary when we see others. You see those boys when he carry bottle water everywhere eh, most of them no even get one room apartment when dem de stay, some of them no de even drink sat her water for there house but when he burst out like this De go shut down the street then go back house go sip garri.